Canada just made it easier to cancel your visa
5 months ago
Canada don introduce new rules wey go affect temporary residents, and e no be small thing o. According to Immigration, Refugees and Citizenship Canada (IRCC), immigration officials now get power to cancel electronic travel authorization (eTAs), work and study permits, and temporary resident visas (TRVs) under certain circumstances.
Dis cancellation go happen if officer get reasonable grounds to believe say you no go comot Canada by di end of your authorized stay, or if na administrative error cause di document to issue, or if di person die. Canada expect approximately 7,000 additional cancellations of these documents. And dis one come after report show say about 50,000 international students wey apply for study permit no show for di school wey dem apply to, including students from Nigeria, Rwanda, Ghana, Iran, India, and China.
So if you dey Canada or planning to go, make sure your documents correct and you follow di rules. Dis new policy na part of Canada effort to reduce di number of pipo wey dey apply to stay. Who else dey affected by dis or get friends wey don experience cancellation? Wetin be your take on whether japa to Canada still worth am?

0 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In