Nollywood sex scenes: wetin una think about Blood Sisters season 2?
5 months ago
So Blood Sisters season 2 drop on Netflix June 5 and the sex scenes don set the whole internet on fire. Nigerians are arguing if we ready for that kind thing or we just hypocrites because we go watch Hollywood do worse and clap.
The pushback is strong o. People say Nigeria too conservative, our religion and culture no gree. Some say the sex scenes no add to the story, na just to copy Western way. And the big one — people fear say e go expose our pikin dem to content wey no be for them, since we no get proper children media.
But me I dey ask: Hollywood fit show everything and nobody talk, but when Nollywood try am, na war? If the scene move the plot and no be just for gbas gbos, why we dey treat our own actors like dem no fit do professional intimate work? The hypocrisy is loud. Be honest, if Beyonce or Rihanna do am, una go call am art. But our own actress? Una go drag her name for market.

0 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In