FG finally admits say inflation and insecurity still dey suffer us
5 months ago
So SGF George Akume come out today for Abuja to mark 2026 Democracy Day and finally confess wetin we all don dey talk since. He say the government know say inflation and insecurity still dey wound Nigerians despite all their reforms. No be small thing oh — after all the noise about Tinubu's policies, dem don admit say we still dey suffer.
Akume talk say inflation don put heavy burden on citizens but claim say e dey ease small small. He also admit say insecurity still dey threaten lives and livelihoods. I mean, na wetin we don dey shout for years now. But the question be say, if dem know, wetin dem dey do about am?
This one just make me wonder — when last you hear any government official talk true about how life really be for us common people?

1 Comment
Sign in to join the discussion
Sign In