🗣️ Gist💔 Relationship Wahala
🎖️CorporalMy husband said I'm 'too expensive' to maintain 😤
I
5 months ago
My husband come tell me yesterday say I be 'luxury item' for this house. Ah ah! The man wey I dey cook for everyday, wash him clothes, bear him four pikin, now I be luxury item?
I tell am say: 'Oga, if I be luxury, why you no dey treat me like one? Where my weekend spa? Where my driver? Where my AC wey dey work 24 hours?'
The man just look at me, scratch him head, and say 'I don buy generator for house, na AC wey dey work when light dey' 😂 Na so we dey suffer and smile for this Lagos. God when will our own better reach?
❤️
💔
1
155
1 Comment
Sign in to join the discussion
Sign In