🎖️Corporal

Peter Obi don call out Tinubu on food matter again

C

5 months ago

Peter Obi don release statement yesterday on his X handle and e no gree for Tinubu at all. He say despite Tinubu declaring food emergency three years ago and buying 2,000 tractors, Nigeria hunger index don worsen from 103rd to 115th out of 123 countries. Now World Bank dey talk say 33 million Nigerians fit experience severe hunger.

Obi talk say we get fast uncultivated land for north wey we no dey use. He say we must invest transparently for agricultural production to guarantee food security and create jobs. Abeg who dey believe say Tinubu government fit fix this thing? Because from wetin I dey see for my street for Yaba, things dey harder than before. Na so we dey chop one meal per day now.

Be honest, you think say any of these politicians care about ordinary Nigerian for 2027?

❤️
💔
0
177

0 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In