Keke drivers in Warri finally snap, I don't blame them one bit
5 months ago
So I just saw video of keke drivers in Warri protesting. Dem say police dey harass them, collect money anyhow. Omo the way those men were shouting, you fit see the frustration inside their eyes.
One man say "we dey suffer, na this small work we dey do, dem no gree make we rest." My guy e pain me. Because if you think about it, these men dey carry passengers from morning till night, fighting potholes, paying for their keke installment, feeding family. Then police come demand for something every corner.
I just dey wonder how many people wey don give up on this kind small business because of wahala. The government talks about creating jobs but the people wey create their own jobs, dem dey make am hard for them.
12 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In