Davido vs Rarara: World Cup jacket don scatter social media
5 months ago
So political singer Dauda Kahutu Rarara don burst for Davido over the jacket wey e wear for World Cup. The jacket dey write 'Bring Dem Home' with names of students and teachers wey kidnappers carry for Oyo State. Rarara say na crude behaviour, say Davido expose Nigeria security secrets to the whole world.
Davido fire back on X, use the word 'Debidoo' to mock how Rarara pronounce im name. Then e talk say real patriotism na to talk the truth about problems wey dey affect society, make we put interest of Nigeria above politics. Some people dey support Rarara say we suppose protect Nigeria image, but plenty people dey with Davido say e only use im fame draw attention to the kidnapping crisis.
Wetin concern me be say, when last una see any musician or celebrity use their platform fight for something wey matter? Or una prefer make dem dey quiet dey collect money?

1 Comment
Sign in to join the discussion
Sign In