🎖️Corporal

This airtime lending man don collect our soul finish

A

5 months ago

I dey sit down today and I dey think about wetin we don become for this country. You know say we dey borrow money to buy airtime? Airtime wey we go use to call people wey no get work? Na wa o.

I hear say the man wey own this airtime lending business na billionaire now. Billionaire from giving poor people small credit for talk. The man see say we dey suffer, he come create way to suffer us more. When you no pay back on Friday, your line go cut and you go beg your friend to borrow you phone. The interest dey chop your money small small until you don pay double.

My neighbour she borrow 200 naira airtime last week. Today she pay 450. She still dey owe. The man don build house for Banana Island from our small small borrow. Wallahi this life no balance at all.

❤️
💔
0
173

0 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In