⚡ Break Story💰 Money Matters
🎖️CorporalMRS finally cut fuel price but others still dey chop our money
C
5 months ago
BREAKING: MRS filling station wey Dangote Refinery back don reduce fuel price to N1,241 per litre for Abuja. Na N76 less from the old N1,317. Dis one come three days after Dangote drop their gantry price by N75.
But the thing wey dey pain me be say NNPC, Ranoil, AA Rano, Empire Energy and others for Abuja never cut their own price. Dem dey still sell at old rate even with crude oil below $80 per barrel. Nigerians don dey vex because these marketers no wan reduce anything.
So we go just continue to suffer while dem dey enjoy? Abeg who get explanation for why dem no dey follow reduce?

❤️
💔
2
175
2 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In