⚡ Break Story🏛️ Political Tea
🔰SergeantDSS Don Turn Court To Wrestling Arena For Sowore
A
4 months ago
So yesterday prison officials finally carry Omoyele Sowore go Kuje Correctional Centre after DSS bin snatch am from court premises like thief. The man don dey held at some unknown location inside the court before dem bring am out by 2pm for Black Maria.
Wetin funny be say Sowore even tell the crowd say he prefer Hilux to that prison van. Na so we dey treat political prisoners like common criminals while the ones wey loot our commonwealth dey ride Prado to court. His supporters dey boo DSS and police for turning court to zoo.
This country sef. The man wey dey demand accountability na him dey sleep for Kuje. When last you see any of our leaders inside that place?

❤️
💔
0
187
0 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In