Wizkid vs Davido , I don tire for this debate, one side dey carry last
4 months ago
See my brother, I have watched this Wizkid vs Davido argument for years and I am convinced say some of una just dey follow crowd. Wizkid has the Grammy, yes. But when last him drop album wey make you feel something? Starboy era was 2014. Made in Lagos was 2020. Since then, wetin? He dey feature for American songs wey nobody for Naija dey dance to for club.
Davido on the other hand, the man no rest. Timeless was 2023 and every track was a banger. He dey give us music wey we can actually use for party, for wedding, for road trip. Unavailable still dey shake my car speaker till today. And the way he carry himself, the philanthropy, the way he dey lift other artists , that one na character. Wizkid dey act like he no want to be Nigerian sometimes.
Before una come for my neck, I know say music is subjective. But answer me one question: if you are at a party and the DJ plays only Wizkid songs for one hour, will the party survive? Or will people start begging for some Davido? I rest my case. Who get the better catalogue for street relevance?

0 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In