🗣️ Gist💬 General
🔰Sergeant

Akor Adams don carry bag for Sevilla? Venezia dey wait am o!

E

4 months ago

Our boy Akor Adams wey just dey find his footing for Sevilla don dey pack for Italy o. The man score 10 goals for La Liga last season, even score against Barcelona, and now Sevilla wey dey struggle financially say dem go sell am. The club new owners, Five Eleven Capital wey Sergio Ramos dey front, don take over with €450 million, but dem still need to sell players to balance book.

Venezia wey just return to Serie A don agree personal terms with Adams already. The agreement don reach, dem just dey wait to talk to Sevilla. But e get twist , Marseille dey push with €30 million price tag. So na who go win this one? Adams know say Sevilla need money and e ready to go where the deal sweet both sides.

This one na proper Nigerian footballer story. From Montpellier to Spain, now Italy calling. I hope our boy choose well because Serie A no be child's play. But with Osimhen and him for Super Eagles attack, e go be something else to watch.

❤️
💔
0
182

0 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In