NREIT just reported 333% profit jump and we are still paying rent
4 months ago
So Nigeria Real Estate Investment Trust don drop their Q1 2026 results and profit before tax jump to N3.19 billion. That is 333.6% increase from last year. Meanwhile I dey my one room in Ikeja and my landlord just increase my rent by 50% because of 'market realities'. Make make sense.
NREIT made N25.06 billion pre-tax profit in 2025 alone, up from N3.1 billion in 2024. Rental income also rise by 174.8% to N4.4 billion. So e be like say the people wey get property dey chop life while we wey dey pay rent dey suffer. The audited results wey dem publish on NGX show say revaluation gains on investment properties contributed N17.3 billion. Meaning say the value of their buildings just dey appreciate while we dey struggle to afford one room.
I just dey wonder, if NREIT wey be real estate company fit make this kind profit, why my landlord still dey use 'maintenance' as excuse to increase rent? Abi na only the big guys dey enjoy this economy? Na so we go dey pay rent till we die?

2 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In