Peter Obi say state police go cause wahala if dem no do am well
4 months ago
So Peter Obi don talk about this state police wey everybody dey shout for. The man say e support am but e get three things wey dey worry am. First na how dem pass the law without public hearing. Oga Obi say the whole process look disorganised, like dem just rush am for 2027 election.
Second na fear say governors go use state police to fight political enemies. You know how our governors dey behave. If dem get their own police, who go check them? Third na transparency. Obi say make dem put strong oversight before implementation. The bill don pass National Assembly but e go need constitution amendment.
Me I just dey ask myself, if state police come tomorrow, the man wey dey fight for local government chairman for my village, e go fit call police on am? Or the governor go use am to arrest opposition? Na wetin dey worry me too. Waffi Comedian don sign out. Abeg who go trust our governors with police?

0 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In