🗣️ Gist📍 Street Gist
🎖️Corporal

Na so dem dey use phone for church

I go church last Sunday, the pastor dey pray serious prayer. Everybody close eye dey shout 'Amen!' But the woman beside me, she open her phone small small. I tink she dey check Bible app.

When I peep, the woman dey scroll Instagram. She dey watch video of somebody dey fry plantain. For inside church! Pastor dey shout 'Fire!' she dey laugh for the plantain video. I nearly cough for her. Naija women no get shame o.

After service, she come ask me say 'Iya Blessing, you see the way God move today?' I just say 'Yes o, God move well well for your phone screen.' She laugh but e be true talk.

❤️
💔
2
158

2 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In