🏅Lieutenant

Remi Tinubu advice: APC chieftain say na for poor people

A

4 months ago

APC chieftain Ayekooto Akindele don come out to defend Mama Remi Tinubu over that her viral advice wey cause wahala. You remember she talk say women fit start small business like frying akara, selling roasted corn and kulikuli to survive. Many people blow up, saying she dey talk down on unemployed youths.

But Ayekooto on his X handle yesterday say the advice na for those wey dey under poverty line. He talk say even the yahooboys and ObiDENTs wey dey cry dey eat those things every day, but dem see am as too low for them. He say dem want to sell cars like Coscharis, Lanre Shitu or Elizade. According to am, "Mama was talking to those on or under the poverty line, who want to retain their dignity while earning a livelihood without sleeping with strangers at motels or dupe foreigners on the Internet. There's dignity in lawful labour."

So wetin be your own? You think say Remi Tinubu advice really fit help poor people, or na just another way to shame those wey dey struggle? Because in this economy wey everything don expensive, akara business fit still feed family?

❤️
💔
0
180

0 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In