🤫 Confess📍 Street Gist

I caught my roommate using my toothbrush to wash his shoes

F
Fire Ant from Lagos

4 months ago

I dey my 200L when I share room with this guy from Imo. Fine boy, well behaved, we even pray together every night. One night I come back early from night class because lecturer no show. I open the door quiet quiet, and I see am.

The guy don pour Omo on my toothbrush, he dey use am scrub the mud from his white sneakers. I just stand there. He see me, he freeze. The toothbrush still dey him hand, foam dey drip. He say "my guy, I go buy you new one." I no even talk. I just pack my things that night and move to my friend's room.

E be like say some people no get boundaries at all. Till today I no fit share anything with anybody. We buy our own garri, our own spoon, everything. The lesson? Some people fit be your brother for church but them no sabi where your toothbrush don pass. God abeg.

❤️
💔
2
183

2 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In