🔰Sergeant

Remi Tinubu said sell akara, presidency is backing her. Wetin be your own?

A

4 months ago

So the presidency don come out to defend Remi Tinubu after she tell Nigerians to go and sell akara and roasted corn. Sunday Dare, the man wey dey speak for them, say he himself sell akara and banana for his mama when he dey grow up for Jos. He say nothing dey wrong with am.

My brother, nobody dey say selling akara dey bad. But the problem be say the woman wey dey talk this thing never experience the kind suffering we dey face. When we dey ask for better policies, better economy, she dey tell us to fry beans. If her pikin or her husband pikin go sell akara for Lagos Island, people go arrest the person for 'disorderly conduct'. So why e dey sweet for us?

Be honest, if you see Remi Tinubu granddaughter for your junction selling akara, you go buy? Or you go think say na setup? Let's argue this.

❤️
💔
0
174

0 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In