NDLEA catch 558,900 tramadol pills inside truck for Lagos o
4 months ago
Na wa o. NDLEA don intercept 558,900 tramadol 250mg pills wey dem hide inside truck for Lagos. Dem even arrest one 75-year-old man for this matter. 75 years old! At that age you still dey carry drugs for people? Make you rest small.
This thing wey dey happen, na because these people no get sense. Tramadol wey suppose be painkiller, now na recreation. Young boys dey abuse am, old men dey import am. NDLEA doing their work but the amount of drugs entering this country still plenty. Over 2.4 million pills from Pakistan alone for one operation.
If you see anybody wey dey sell or abuse tramadol, run. That thing go finish your brain before you know. The 75-year-old man sef, wetin dey inside your head at that age?

5 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In