🎖️Corporal

Mr Real talk say he prefer bandit life to selling akara... na wa o

M

4 months ago

I just hear wetin Mr Real talk about Remi Tinubu advice. The man say he rather join bandits than sell akara. Chai! See the way young people dey talk now.

My own mother sell groundnut for motor park for 15 years before she fit open her own shop. Nobody tell am say na shame. But now, if you no get big car and big house, dem go call you useless.

Who born all these children wey dey shame honest work? Na so we go end up with nobody wey want do anything again.

❤️
💔
3
190

3 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In