🔰Sergeant

NANS wants to shut down South African businesses by June 30

A

4 months ago

NANS just held a press conference yesterday and say dem go shut down all South African businesses for Nigeria if the killing of our people for South Africa no stop. Dem mention the case of Big Joe wey dem kill for Witbank, Mpumalanga Province. The students body say "nobody get monopoly of violence" and dem go occupy multi-billion Naira businesses.

I dey market everyday, I know wetin happen when you start targeting businesses. Yes, I understand the anger, but who go suffer pass? Na Nigerian workers for Shoprite and MTN. The government for South Africa dey watch, our government dey talk. At the end of the day, na poor Nigerian wey dey work for those places go lose job. NANS dey right for the sentiment, but the strategy dey shaky. Be honest, you think shutting down businesses go stop xenophobia or just create more wahala for us here?

❤️
💔
0
211

0 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In