🗣️ Gist🏢 Oga Wahala
🎖️Corporal

See the way market women dey calculate exchange rate for their head

M

4 months ago

Yesterday my apprentice Chidinma come tell me say she wan buy phone for her boyfriend. I ask her how much she get. She say she save 80k. I laugh. I say my child, the phone wey you want na 250k now. She say but last year e be 120k. I say last year dollar be 900. Now na 1360. You think say phone go still be same price?

She just dey look me like say I dey speak Chinese. I tell her, my dear, if you no understand exchange rate, just hold your money. The phone wey you want today go be 300k next month. Na the same thing wey happen for market. Basket of tomato wey I dey sell for 5000 last year, now na 8500. People dey curse me but the supplier don increase price. Abeg who I go curse?

Na wa o. The only thing wey never increase na people wey no get sense. Dem still dey behave like 2015.

❤️
💔
7
172

7 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In