If you no get money for date, just stay at home
4 months ago
I tire for this generation o. You go see guy wey dey carry girl go date, but e no get even transport money to go back. The girl go pay for her own food sef. Ah! Wetin be dat?
If you no get money, just tell the girl make una chop at home. Cook am yourself, show her say you get sense. Na the effort wey you put in dey sweet pass the money wey you spend. But some of these guys dey form big boy with empty pocket. By the time bill come, dem go start dey check phone as if dem dey transfer money. Everybody for the restaurant go sabi say you dey suffer.
My guy, no be by force to date. If your account no balance, stay home, watch match, drink garri. E better pass to shame yourself for public. Money no be everything, but pretending to get am na the worst thing you fit do. Abi, I lie?
1 Comment
Sign in to join the discussion
Sign In