💬 Discuss📍 Street Gist
🎖️CorporalAba vs Onitsha market , which one get the better hustle?
K
4 months ago
I dey tell you, if you never sell anything for Onitsha market, you no sabi wahala. Dem go price your goods before you even open your mouth. But Aba... Aba na different level. The customer go just pick the item, inspect am like say na police investigation, drop am, and walk away without saying a word. Then come back after three hours and buy am at your price.
Onitsha people dey talk fast and move faster. Aba people dey calculate every kobo before dem release am. Which one be the real school of hustle? I have shops for both places and I still can't decide. Onitsha give you volume but Aba give you loyalty.
Which market you prefer? And why your answer better be correct o.
❤️
💔
0
161
0 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In