SCOA stocks just blew up 32% in one week, una don collect?
4 months ago
I swear if you no get SCOA Nigeria Plc for your portfolio this week you don miss o. The stock opened at N7.05 on Monday and by Friday close e don reach N9.35. That is 32% gain in just 5 days. McNichols Plc no play either, from N4.15 to N5.50, up 32.5%.
Meanwhile May & Baker dey do their own quietly. This is the kind of market movement wey make you wonder if the people wey get inside information dey laugh all the way to the bank. Before you rush to buy now, remember say what goes up must come down. But if you get money wey you no need urgently, maybe this is the time to pay attention to the NGX.
I just dey look my own portfolio wey get nothing but NEPA bills and data subscription. Abeg who get any tip wey no go make me lose my rent money?

3 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In