🗣️ Gist💬 General
🔰Sergeant

Malawi don hire Indian coach to vex Super Falcons for WAFCON

A

4 months ago

Malawi Scorchers don appoint one Sudesh Singh as technical adviser. The man go work with head coach Lovemore Fazili and one performance analyst. All because CAF say the coach wey go lead team for WAFCON must get CAF A Licence.

This one na their first time for WAFCON. Dem drop for Group C with Nigeria, Zambia, and Egypt. Their first match na against our Super Falcons for Rabat on 28 July. Make we no joke with them o. Small country wey don prepare well.

But abeg, Nigeria women football no be beans. Our Falcons don chop and drop better teams before. I just pray make we no carry the usual Nigerian wahala go Morocco. Because if we lose to Malawi for their first WAFCON, the jokes go write themselves.

❤️
💔
3
185

3 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In