This man Dickson Iroegbu don warn us well well about 2027
4 months ago
Human rights activist Dickson Iroegbu don talk say if anybody try stop NDC from being on ballot in 2027, there will be revolution and anarchy for this country. He talk this on Mic-On podcast with Seun Okinbaloye on Saturday night, after some Federal High Court in Lokoja set aside their earlier judgment wey say INEC must register NDC as political party.
Iroegbu say Tinubu is overrated, that he succeed in grabbing power in 2023 but 2027 go shock am. He say if Nigerians no end APC, APC go end Nigeria. This man dey talk as person wey don see am before. The fear of Peter Obi as NDC presidential candidate dey give APC and Tinubu headache.
Be honest, you think say INEC go allow NDC on ballot or dem go use court to block am like dem dey do?

0 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In