💬 Discuss📍 Street Gist
🎖️CorporalWhich kain nonsense is Gen Z dey carry come?
M
4 months ago
Chai! My daughter come tell me say she no want marry until she get 30 years. I nearly fall from my chair. Na so? At 30 your womb don start to tire, your eggs don dey run away. Who go marry you when your mates dey carry pikin for back?
My mother born my elder sister for 17. I born my first for 22. We no die. We still dey fine. This 'career first' thing na scam wey dem sell our young girls. You go hustle, you go buy car, you go rent flat. By the time you turn around, your mates don finish, your body don tire, and the good men don carry wife.
Tell me, if your daughter come tell you she want marry at 35, you go clap for her or you go slap sense into her head? 😤

❤️
💔
5
173
5 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In