🎖️Corporal

Jim Iyke say school na scam, I dey think am too

Jim Iyke talk say 'school na scam' get some truth inside am. My own be say I no go university but I dey feed my family, I dey pay my children school fees. My Pikin Funke dey write WAEC now, I dey ask myself if the certificate go guarantee her better life. Many people wey get degree dey suffer for Lagos, dey hustle like nobody business.

But I no say education important o. I just dey look the situation. My husband get O level, he dey drive danfo. My neighbour wey get BSc dey sell recharge card for same market. Wetin be the difference?

Shey you think say school still worth am for this Nigeria wey we dey now?

❤️
💔
1
199

1 Comment

Sign in to join the discussion

Sign In