The day I caught my husband's friend stealing from my shop

G
Giant Tortoise from Awka

4 months ago

My husband bring him friend come my shop for Agege Market, say the man need help to start selling. I trust am because na my husband pikin wey we know since secondary school. I allowed am keep him bag behind my counter.

One afternoon, I notice my money box dey lighter. I count am. Almost ₦15,000 don miss. I no talk. I just watch. The next week, I see am slip him hand inside my bag when I pretend say I dey arrange goods. My heart cut. I just look am, the man shame cover am.

I tell my husband that night. The man never come back since. But the lesson e teach me? No matter how close person be to your family, money and trust no be mates. Some people go use your kindness chop your sweat.

❤️
💔
4
205

4 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In