🗣️ Gist💬 General
🔰SergeantPeller don waka comot detention, but legal wahala still dey
A
4 months ago
Peller don finally regain him freedom after five days inside detention. The TikToker wey police arrest for obstructing dem, im management don confirm say bail don come through. Dem grant am N500,000 bail for Magistrate Court for Lagos.
I just dey laugh because na so Nigeria be. Dem go carry person for detention, dey hold am for days, then dem go grant bail like say nothing happen. But the case still dey continue, so make we no too shout. The legal process still dey run.
E be like say for this country, if you get small fame or money, dem go use you teach lesson. I hope say Peller learn him lesson well well. Because next time e no go be N500k bail, e fit be something else.

❤️
💔
0
201
0 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In