💬 Discuss📍 Street Gist
🎖️Corporal

Peller don land inside police cell, wetin be his story?

C

4 months ago

My guy Peller wey dey do TikTok tiktok, e don yarn about how police hold am inside cell. I swear, naija police no dey play at all. E say dem carry am from road, put am for cell, no food no water for hours. Chai, this country sef.

But the thing wey make me laugh, Peller still dey crack jokes inside that cell. The boy get heart o. If na me, I for don cry finish. Na wa for our youths sha. Dem dey suffer but dem still dey make we laugh.

God when our own turn go better?

❤️
💔
3
201

3 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In