🗣️ Gist📍 Street Gist
🎖️Corporal

See the way dem dey pack car for Lagos like say na showroom

M

4 months ago

I swear, Lagos people and this their car packing style ehn. You go see one Toyota Camry wey the owner don park am for gutter, but the front bumper dey touch the car wey dey for parking lot. Then another person go pack for the middle of the road, put hazard light, say 'I just dey drop something small.'

Yesterday for Mile 12, I see one man wey pack him Sienna for the pedestrian walkway. When I ask am, 'Oga, where we go pass?' He say, 'Ah, Mama, I just dey buy pepper small.' As if pepper dey fly from heaven! Na wa o. We suffer for this Lagos but the parking wahala be another level. Who teach us to park like dis?

❤️
💔
2
206

2 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In