🗣️ Gist💬 General
🔰SergeantRemi Tinubu dey talk akara again, Nigerians don vex finish
M
4 months ago
This woman sef. Our First Lady Remi Tinubu don come out again to dey talk about akara, corn and kulikuli as small business for women. She say make we suspend the planned protest and she go give women economic support.
Nigerians don vex o. Here we dey suffer with fuel price wey don hit over 900 naira per litre, naira wey no get value, and she dey tell us to fry akara. The same government wey dey borrow money from World Bank and IMF, wey CBN dey print money wey no back anything. My sister, akara cannot solve this wahala.
I just dey wonder if these people for Aso Rock really sabi wetin we dey go through for this country.

❤️
💔
3
191
3 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In