💬 Discuss📍 Street Gist
🎖️Corporal

Nigerian men, why una dey fear to say sorry?

A

4 months ago

I just dey think about something. My friend call me yesterday, she tell me say her husband do her wayo. He come home late, no call, no text. She vex, she cook for am, she clean for am, she do everything. The next morning, the man just wake up, drink his tea, and carry bag go work. No sorry, no explanation, nothing.

I dey wonder, why Nigerian men find am so hard to just say sorry? Even when dem know say dem do wrong. Instead, dem go act like nothing happen. Or worse, dem go buy something for you and pretend say that is the apology. But the words never come out.

Wallahi, I no dey talk for all men o. Some men dey humble and dem know how to apologize well. But e plenty. My people, why is sorry so hard for some men to say? Na big problem abi na small thing?

❤️
💔
2
173

2 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In