🔰Sergeant

Atiku no fit see Oriire pupils don free and e dey vex me

A

4 months ago

Bayo Onanuga don call out Atiku Abubakar because the man never talk anything since Oriire pupils and their teachers don come out. Almost 18 hours after dem regain freedom, Atiku still dey mute. But wen dem dey captivity for 57 days, e dey use am campaign weapon every time. Now dat good news come, e no fit even type 'congratulations' to the security agencies or the victims.

Peter Obi wey be NDC candidate at least talk and call for thanksgiving. E no even praise Tinubu, e just show human feeling. Atiku dey wait for bad news again abi? If e no happy say those children don see light, wetin e really want for this country? Be honest, if this one no show you say some politicians just dey use our suffering for votes, wetin else go convince you?

❤️
💔
0
180

0 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In