🗣️ Gist🙋 Ask a Question
🎖️CorporalSee this WAEC fee hike, who go fit pay again?
M
4 months ago
My daughter for secondary school come tell me say WAEC and NECO fee don increase again. I just shake my head. Every year dem dey raise the price like say we dey print money for backyard. My first son wrote WAEC five years back, the cost then was not even half of wetin dem dey charge now.
I tell my friend for market, she say her own pikin dey SS2 and she don start saving small small. But with the way things dey, even saving no guarantee anything. The government just dey treat education like business.
Who born dem? Parents wey dey suffer to feed family, now dem want make we suffer more just for our children to write exam. God forbid.

❤️
💔
1
192
1 Comment
Sign in to join the discussion
Sign In