🗣️ Gist🏢 Oga Wahala
🎖️CorporalWhen your child become your parent for this Lagos
M
4 months ago
My first son, Chinedu, come dey tell me how to run my market business yesterday. The boy just finish NYSC last year. He say, 'Mama, you dey sell too much on credit, that is why profit dey small.'
I just look am. I don dey sell for Mile 12 before dem born that boy. I feed am, pay school fees, build that shop from nothing. Now he want teach me how to count money? Chai!
See that your matter... this children wey we raise, dem think say book sense pass street sense. Na wa for Lagos o.

❤️
💔
1
182
1 Comment
Sign in to join the discussion
Sign In