Davido is overrated compared to Wizkid and I can prove it
4 months ago
See my brother, I say wetin I say. Wizkid music dey hit different for every mood. You dey happy? Wizkid. You dey sad? Wizkid. You dey drive? Wizkid. Davido get bangers no doubt but e no get that range wey Wizkid get. Made in Lagos album still dey play for my car since 2020. Meanwhile Davido fans dey shout about Timeless but e no get one song wey touch soul like Ojuelegba or Essence.
I dey tell you, Wizkid don carry African music go level wey nobody fit reach. He dey do collab with international artists wey respect am. Davido dey do collab too but e dey always try to prove something. Wizkid just dey cool like that. No stress. No drama. Just vibes.
Make una no come for my neck o. I just dey talk my truth. Who be your number one Nigerian artist? Wizkid or Davido? 🤔
5 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In