🗣️ Gist💬 General
🔰Sergeant

Italy don show us pepper for 2026 visa free travel list

A

4 months ago

See Italy o. Dem just drop their 2026 visa free list and only Mauritius and Seychelles from Africa dey there. Nigeria, Ghana, South Africa, all of us we no make am. We still need to go apply for Schengen visa for Italian embassy before we fit travel.

This thing pain me because our own passport weak. Dem dey treat us like second class citizens. Even small Malta wey be tiny island, dem get visa free for 182 countries but we wey get 200 million people we no fit enter anywhere without wahala.

When I see this list I just laugh. Our leaders dey travel with their diplomatic passports but we for the street dey suffer. Abeg make we start praying for our passport to get power like Maltese passport wey rank number 5 for the world.

❤️
💔
0
178

0 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In