🗣️ Gist📍 Street Gist
🎖️CorporalNa so we dey suffer for Lagos, but we still dey form
I
4 months ago
My sister Iya Bisi come my shop yesterday dey complain say she no get money for transport. I say wetin happen? She say her husband give her N500 for whole week. N500 for transport for Lagos! Abeg wetin person go do with N500 for this Lagos?
She dey wear gele wey cost N15,000 for wedding last week. She carry bag wey be original Gucci wey her husband buy for her for Balogun. But she no get transport money. Na so we dey suffer and dey form at the same time.
I tell her make she sell that bag. She look at me like I say she kill person. Na wa for Naija women o. We prefer to suffer with style than to survive with sense.

❤️
💔
4
171
4 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In