🔰Sergeant

Obanikoro finally admit why Tinubu lost Lagos in 2023

A

4 months ago

Former Minister Musiliu Obanikoro don finally come out to say wetin really happen for Lagos during the 2023 election. He talk am for Channels TV podcast say na Muslim-Muslim ticket defeat us for Lagos, not Peter Obi. I just dey laugh because all these people wey dey shout say Obi won Lagos, una see wetin Obanikoro don confess now.

Obanikoro say people were afraid say Tinubu go relegate Christians but he say Tinubu no be religious bigot, say im wife na pastor and im son Seyi na Christian. Abeg na wetin be the difference between fear and reality? If people fear am and still lose, abi na the fear win the election for us? Make we talk true, if Tinubu never pick Muslim running mate, e for carry Lagos. Simple economics — you no fit sell Muslim-Muslim ticket to a state wey get Christian governor and Christian population like Lagos.

Be honest, if you be Christian voter for Lagos in 2023, you go vote for Muslim-Muslim ticket? Let's argue this.

❤️
💔
0
198

0 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In