🔰Sergeant

Oshiomhole called Peter Obi a trader, said he can't be president

O

3 months ago

Edo North Senator Adams Oshiomhole don finish Peter Obi for TVC interview yesterday. The man say Peter Obi is a trader with short-term calculation, that traders dey think about 3 to 6 months turnover, not long-term vision like manufacturers or investors wey dey sweat for 2 to 3 years to build factory.

Oshiomhole also talk say the Peter Obi wey dey governor for Anambra is not the same today, say Obi abandon APGA after Ojukwu's memory and become political wanderer wey join Atiku. He even say Obi's business na to export job and import unemployment to Nigeria, that he owns a shopping mall.

This one get me thinking. Oshiomhole dey talk from experience of being labour leader and governor, but calling Obi trader wey cannot think long-term? Abeg, which politician for Nigeria don ever show long-term planning? At least Obi fit account for his tenure as governor. Let's argue this — is Oshiomhole right or this is just political bitterness?

❤️
💔
0
184

0 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In