🔰Sergeant

Tyla concert boycott: Are we really going to beat people up?

T

3 months ago

So this Tyla show wey dem schedule for December for Lagos, the whole internet don turn am to war front. Yesterday celebrities don launch campaign say South Africa thinks we're fools and we must not allow am. Do2dtun don write say "If you go for that Tyla's show then you are a bastard," and Pere Egbi even dey beg Immigration not to give her visa. But the one wey shock me pass na Isa Bako wey say make people just go to the venue and wait outside to beat up anybody wey attend. Na so we dey do things now? We dey fight xenophobia with violence for our own soil?

I understand the anger, make no mistake. Our people dey die for South Africa and Tyla never talk anything. But if we start beating people for going to a concert, how we different from the very people we dey condemn? Solomon Buchi talk say the show must not happen because she never speak up, and I get that. But beating people? That's where I draw the line.

At the end of the day, na the organizers and Tyla wey need to hear us, not the innocent fans wey just wan enjoy music. But I no go lie, the anger dey real. Dem say na Tinubu fail us, say na why she get audacity. Abeg, una wey dey support the boycott, una go really beat somebody wey buy ticket? Be honest.

❤️
💔
8
187

8 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In