⚡ Break Story💰 Money Matters
🏅LieutenantNo light, no light, but they say subsidy go die by 2027.
A
3 months ago
So government dey tell us say dem go stop electricity subsidy from 2027, but no tariff hike for now. Abeg, who dem wan fool? If subsidy go disappear, na your pocket go feel am first before any "vulnerable consumer" protection wey dem dey promise. We don hear this kind story before, fuel subsidy gone, now light subsidy next. Dem say na for our own good, but when last dem remove subsidy and life become better?The real question be say: if dem no fit give us stable light with subsidy, how dem go manage without am? Una ready for another round of "temporary" hardship wey go become permanent?

❤️
💔
6
181
6 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In