Wike Dey Claim Say He Be Most Experienced Politician Since 1999, Abeg Who Agrees?
3 months ago
FCT Minister Nyesom Wike don talk again o. During a media chat for Port Harcourt today, he say himself say na him be the most experienced politician for Rivers State since 1999. Na serious confidence, but na so the man dey always talk.
E say "From 1999, I can say that I am the most experienced politician that is still on." E still add say those wey deceive Governor Siminalayi Fubara into the face-off with am, dem get nothing good to add to the state. This one na direct jab for those four politicians wey e don accuse of misleading Fubara since 2023.
Person go ask, experience for wetin? Na all this crisis wey don scatter Rivers State since 2023? Or na experience for how to dey hold power tight? Make una tell me, if Wike truly be the most experienced, why the state still dey find peace? Abi na only him sabi the game?

0 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In