🎖️Corporal

Tyla Drops Lagos Show , But Di Real Question Be Who Really Suffer?

C

3 months ago

South African singer Tyla don remove Lagos from her world tour after Nigerians call am out over xenophobia wey dey happen for South Africa. Some pipo dey say make we boycott her show, while others like Sowore dey talk say make we no put di anger for her head , na our own leaders and di South African government be di real problem. But di thing wey dey pain pass be say, when dem no give Ayra Starr visa to perform for South Africa, nobody bin dey shout for her , so why we dey expect Tyla to talk when our own goment no dey protect us?Which one be di better protest , boycotting one artist or demanding accountability from di people wey actually dey control di visa and di politics?
❤️
💔
5
169

5 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In