Abia dey charge N200m for campaign billboard, na pure APC handiwork
3 months ago
Kenneth Okonkwo don blow the whistle on Abia State o. Dem say any presidential candidate wey wan put campaign billboard for Abia go pay N200 million, and governorship candidate go pay N150 million. Okonkwo say na APC agenda using Governor Alex Otti to suffocate opposition. He talk am on Channels TV Sunrise Daily last Friday, say "It's unfortunate that in Nigeria, the ruling party has made it impossible for the opposition to strive."
Multiply N200m by 36 states plus FCT, you go see say na pure extortion. How person wey no get government pocket go afford that kind money? This na clear case of power wey dey use money to kill democracy. Abia State Structure for Signage and Advertising Agency, ABSSAA, na dem put this fee. Question wey dey my mind be say, Governor Otti wey people see as anti-establishment, how e go just fall for this APC trap? Una wey dey Abia, this thing dey make sense to una?

0 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In