Tinubu left primary and secondary school blank for 2027 form, una see am?

S
Steel Gorilla from Onitsha

3 months ago

President Bola Ahmed Tinubu don submit im EC9 form to INEC for the 2027 election and the thing wey dey worry people be say im leave the primary and secondary school qualification spaces blank. Im only list Bachelor of Science from Chicago State University, 1979, and attach im NYSC certificate. But no primary school, no secondary school, nothing for those sections.

Meanwhile Peter Obi and Atiku Abubakar don show their full educational history from primary school to university. Obi even list St. Augustine's Primary School and Christ the King College Onitsha. Atiku list First School Leaving Certificate from 1954. So why Tinubu wey dey contest for president no fit remember where im go primary school? This one wey dey hide im past dey make person think say something dey behind am.

Section 33 of Electoral Act say anybody wey believe say the information be false fit go court with evidence. So the question be, who go challenge this one and wetin dem go find?

❤️
💔
0
202

0 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In