Tyla concert no venue, Nigerians say boycott, and honestly we are tired
3 months ago
Tyla wey win Grammy don book Lagos show but e no get venue, and the way Nigerians dey react e be like say the girl don offend us before she even land. People dey call for boycott because dem feel say na disrespect to sell tickets for concert wey no get place wey go hold am. Some fans don already buy ticket, now dem dey stranded.
The thing wey make am worse na say this na the same energy wey Nigerians dey give foreign artists, we dey show love, we dey pack out venues, but when dem come here dem no take us serious. Tyla no even talk anything, e just dey quiet while organizers dey run around. If na Lagos, na Lagos, but you no fit sell ticket without venue, abi?
Make una tell me, if you don buy ticket for this kind show, you go still attend or you go join the boycott? Be honest.

0 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In